Re–Team Nigeria’s Poor Olympics Performance

Posted on August 10, 2012

0


The following is culled from Nairaland.

Question:

What do you think is the cause of the dismal performance of Team Nigeria in the London 2012 Olympics?
A.POOR PREPARATION
B.LACK OF FUNDS
C.CORRUPTION
D.GEJ

Best answer:

I dey vex 4 dis country wey i come frm no be joke oooo!!! Small thing Ogoni man go jump enter water like fish for days we no go see dem. See olympics nah, go swim,dem dey fear water.

Zero medal 4 Naija Hausa man go enter boat dey shout argungu fishing festival. See rowing 4 olympics, dem no dey.

Zero medal 4 Naija Fulani herdsmen fit shoot arrow from 1km kill anyone wey wan steal dem cow, olympics reach make dem go do archery, dem no sabi shoot again.

Zero medal 4 Naija Igbo man go run from Sokoto to Aba at the slightest provocation by Boko. See marathon 4 olympics, dem no shw face.

Zero medal 4 Naija Agbero for park no mind pursue bus for road. See 100metres race 4 Olympics, dem no sabi run again.

ZERO medal 4 Naija Yoruba man go remove clothes, wrist watch and pant to fight 4 Ojuelegba. See boxing 4 olympics,we no see dem.

Zero medal 4 Naija Warri man go say warri no dey carry last….. na wetin Blessing Okagbare, our own warri babe dey do for last 4 women 200metres race abi she think say one person dey her back?

Zero medal 4 Naija Na who even start that nonsense called NAIJA GOT TALENT sef…?!

Posted in: Africa, Nigeria, sports